23/03/2016
In first WAEC examination, Akpos was asked to complete the following:
1) WAEC : He who fights and run away?
AKPOS : E don surrender be dat, na dear catch am
2) WAEC : A rolling stone?
AKPOS: No fit just dey roll, na person push am..
3) WAEC : He who lives in a glass house? AKPOS : Na rich politician ego be....
4) WAEC : A stitch in time?
AKPOS : Dey prevent further tear tear...
5)WAEC : Birds of the same feathers
AKPOS : Na de same mama born dem...
6) WAEC : One gud turn?
AKPOS : Na correct power steering fit do am...
7) WAEC : A bird in hand?
AKPOS : Wetin e wan be again? If no be barbeque.... Dem plenty for chicken republic
8)WAEC : Half a loaf is better than?
AKPOS : beans and gari, soaking without sugar...
9) WAEC : A journey of a thousand miles?
AKPOS : Na de person wahala be dat,na why eno enter car or aeroplane jeje...
10) WAEC : He who laugh last?
AKPOS: Get brain problem, make dem examine am bcs na beginning of madness be dat...
11) WAEC : A patient dog?
AKPOS : Na hunger go kill am...
12) WAEC : All work and no play?
AKPOS : Na bank job be dat bros...
13) WAEC : Once beaten?
AKPORS : Na revenge go follow be dat...
14) WAEC : A fool at forty?
AKPOS : I never see for Naija, our own dey start at 50...